By Ugo Ude Anna
Relax.
If onyibo supri-supri
dey sweet for ear,
make this capping dull
the sugar, con deliver the message.
After all, truth bitter,
No be sweet mouth.
.
Ground, na every man get am.
Mini skirt no be colour wey sisi Maria dey fly.
Man wey no fit keep himself,
for himself and by himself
naim dey chop sand-sand garri for six feet.
.
Kpor. Kpor.
You dey hear?
Na your coffin dey sound
Say e wear mini-skirt
No mean say na your colour e dey fly
Nothing like green light
E be yes or you off am
Nobody pikin be traffic light.
.
One word, na saliva too plenty
Discussion3 Comments
“Man wey no fit keep himself, for himself and by himself naim dey chop sand-sand garri for six feet”….
I love this line and every other piece in this work. So well constructed and educative pidgin.
The crux of the matter is that, self control is key to ward off rape. Thanks for this message.
Hot!!!
stunning! ‘nobody pikin be traffic light’